Skip to main content

Ministerial list: No single pesin below di age of 35 dey Buhari ministerial list

Ministerial list: No single pesin below di age of 35 dey Buhari ministerial list

Ministerial list: No single pesin below di age of 35 dey Buhari ministerial list

FocalPoint Reports------------------------- NEWS IN Pidgin All in one,

Image copyrightMUHAMMADU BUHARI

Di last time perhaps wey any young Nigerian fit boast say dia padi-padi collect appointment as a federal minister na during di fourth republic for 2003 wen di likes of Chukwuemeka Chikelu and Frank Nweke Jr (37 years old dat time) bin serve as federal ministers.

16 years later, many dey tink say tins go change wen Nigerian Senate begin di ministerial screening for President Muhammadu Buhari latest list of ministerial nominees on Wednesday July 24, 2019.

"No single pesin below di age of 35 dey for di Ministerial nominees President Muhammadu Buhari announce on Tuesday for floor of di National Assembly wey go follow serve second term in office."

Na wetin Samson Itodo, di Executive Director, YIAGA AFRICA tell BBC News Pidgin.

Meet former Ministers wey no make Buhari new list

Tori be say of all di 43 nominees inside di ministerial list, di youngest na 43 years Sadiya Umar Farouq wey don be National Treasurer of Nigeria goment ruling APC party.

"Di noticeable absence of young people under di age of 35 inside di ministerial nominees wey Senate President Ahmed Lawan read come to us and di entire Nigerian youths as a big surprise.

"Indeed e dey disappointing to see say upon di giant achievement wey my young pipo don achieve especially for di area of politics and leadership, President Muhammadu Buhari neva see any pesin below di age of 35 worthy of any ministerial position." Itodo add.

Image copyrightOTHERImage exampleNa only 7 women make di Ministerial list

Already Senate don screen (interview) and confam 10 nominees: Sharon Ikaezor, George Akume, Godswill Akpabio, Olamilekan Adegbite, Chibuike Amaechi, Adamu Adamu, Olorunnibe Mamora, Chukwuemeka Nwajuiba, Uchechukwu Ogar, Ogbonnanya Onu (Most of dem dey in dia 50s).

Houses of Assembly, three or four pipo wey under 40s don be Speakers, young pipo dey make great achievement inside private sector, as social entrepreneurs and inside public sector dem dey get accolades locally and internationally, according to Yemi Adamolekun, di Executive Director, of EiENigeria wey yarn win BBC tori pesin Daniel Semeniworima

"Di Vice-President's office get quite a number of young pipo e.g Jumoke Oduwole wey dey lead di Ease of Doing Business Initiative. Mr President no fit say he no for get di names of qualified young pipo"

Image copyrightYEMI ADAMOLEKUNImage exampleYemi Adamolekun na Nigerian politicalactivist

Wen President Muhammadu Buhari sign di Not Too Young To Run Act for 2018 im even cari mouth tok say young pipo get capacity to get appointment as big ogas for im goment.

Why Buhari list vex some APC pipo

Di Oga for YIAGA Africa say;"Even though dem never assign role to di ministerial nominees, e dey obvious from di list say di minister of youth and sports no go be young pesin as none of di nominees dey under di age of 35 not to talk of di new National youth policy wey classify youth to be between 15 and 29 years old. Dis no relate to wetin President Buhari show to young pipo wen im sign di Not Too Young To run bill into law.

"Di way we don see Speakers wey dey under di age of 35 for State Houses of Assembly wey dey Oyo, Zamfara, Kwara and Plateau no only show say young pipo dey ready for ministerial positions but say dem dey ready to deliver well well," im tok.

Image copyrightSAMSON ITODOImage exampleSamson Itodo wey follow coordinate di Not Too Young To Run campaign to become law inside Nigeria

"As di wait for President Muhammadu Buhari's cabinet don end , we still dey wait for dem to include young pipo for im cabinet. State govnors across Nigeria get di chance to change am as dem appoint ogbonge young pipo wey get character to head dia various commissions," Itodo add.

Meet di women wey make Buhari list

As di list land, Nigeria main opposition Peoples Democratic party - PDP condemn di list say 'e further show say President Buhari and di goment APC party disrespect, no dey careful about Nigerians and no in any way reflect dia hope and eagerness for a better Nigeria.'

Meanwhile Nigerian Senators go screen 8 more nominees on Thursday July 25, 2019 and dem don change dia rules to even sit on Friday July 26 and Monday July 29 to sharperly interview di remaining list of nominees, dem also agree to close very late every day.

Comments

Popular posts from this blog

Breaking: ASUU suspends 2-week warning strike

The Academic Staff Union of Universities, ASUU, has suspended its two-week warning strike it declared last week across all public universities in the country. The union announced the suspension on Wednesday at a press conference held at its headquarters in Abuja. President of ASUU, Chris Piwuna, who read a prepared speech before newsmen, explained that the development followed intervention by the Senate and some other well-meaning Nigerians. However, he sad the National Executive Council of the Union resolved to give the government a one-month window to address all contending areas.

JUST IN: If Tinubu Had Told Me, I Wouldn’t Have Agreed To Rivers State Of Emergency Rule – Wike

The Minister of the Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, has stated that he would not have agreed with President Bola Ahmed Tinubu if he had discussed his move to declare a State of Emergency in Rivers State. Wike noted that he is not in conflict with the suspended Rivers State Governor,      Sim Fubara  He stressed his opposition on the State of Emergency rule, stating that only the President knows the right time to lift it. While speaking to journalists in Abuja on Monday, Wike remarked that Fubara has permitted himself to be manipulated by his adversaries to oppose him. The FCT Minister said: “ I made it clear that this impunity will not stand, so what is happening in PDP is what I call undertakers because I see no reason why you will put yourself under that kind of crisis. “I don’t have any crisis with him (Fubara). I’m not the President who declared a State of Emergency; if Mr President had called me, I wouldn’t have agreed to the State of Emergenc...

Woman Burned to Death, Accused of Kidnapping 7yrs Old Boy in Delta

By Tessy ogbemi An angry mob set ablaze a woman accused in a failed child kidnapping attempt in Agbarho community, Ughelli North Local Government Area of Delta State.  The incident happened on Wednesday, September 24, 2025.  An eyewitness disclosed at the scene of the incident at Ekwvere Road claimed that the woman hid the seven year old boy she allegedly abducted in a sack, adding that she was even carrying a Bible on one hand.  Community sources said some residents in the area accosted the lady when they observed the way she was dragging the sack, to know what she had in it.  "She was unstable when they asked her to disclose what she was carrying in the sack. When the bag was forced open, they found a seven year old child in it. They shouted and it attracted a large crowd,” a source said.  It was gathered that the angry mob immediately brought a used tyre to the scene, which they forced down her neck after beating her to a pulp.  “The lady and the tyre we...